.
MISS SIMPLICITY - As we knw sey last week Oluomo of oshodi do him birthday nd pipu sama d media wit picture of girlz wey no wear bra nd dem call d party "Braless party" bt now oluomo don come out com tok sey him no do that kind party o. He tok sey him na confirm Muslim wey don go Mecca nd Saudi Arabia nd him dey
send pipu go mecca every yr nd him knw wetin Allah tok abt respecting women body, he tok sey d place wey him take do d party big nd d girls wey dem snap na ashewo nd club girls wey no even near him party bcos d place big wella. Musiliu Akinsanya wey we knw as Mc Oluomo tok sey d story nd d pictures na fake o sake of sey him still dey wonder sey wetin him go fit gain from dat kind party? He even tok sey him knw sey him get enemies nd him believe sey na dem go take d pictures of those ashewo nd club girlz bt him knw sey dem no go fit spoil him name bcos Baba God o, dey him back nd d house wey God don build, nobody go fit scatter ham..
Hmmmm....
No comments:
Post a Comment