Dem don catch one Naija guy on Thursday March 24, when India Narcotics Control Bureau (NCB) plus dem Anti-Narcotics Cell (ANC) for the Mumbai police go waylaid one kain international drug pipu wey dey take postal services carry drug enter dem country. We dem catch the Naija guy, Frank William, na 600gm of cocaine wey dem import from
Latin America dem see for him dommot. Tori yarn us say the cocaine money na like Rs 4 crore, and na post dem take send am. NCB say as dem hear the gist, na him dem go collabo with the postal services plus ANC and na for 1 week dem take dey follow the parcel wey pass like 2 to 3 countries. Na when the parcel land for post office wey dey Khoparkhairane for Navi Mumbai, the officers catch Mr Frank, when he come collect am
No comments:
Post a Comment