See levels, as MTVBASE don polongo the pipu wey go be host for one kain new TV show wey dem call, Lip Sync Battle Africa, and na the programme go be the first programme wey dey local to the ogbonge station for Africa. Our sure guy for Naija, D’Banj plus one South African entertainment person, Pearl Thusi go dey host the show host Lip Sync Battle Africa, where celebs go dey compete against eachother as dem go dey lip sync wey we Sabi as mime, song wey dem like. Na Pearl Thusi gangan go dey host the show, Koko Master go just dey put sugar once once. The TV show, Lip Sync Battle Africa go start in April 2016 on MTV Base (DStv channel 322).
No comments:
Post a Comment