Friday, March 4, 2016

DAVIDO DON SIGN MAYOKUN TO HIM HKN RECORD LABEL

We beta pikin,  wey dey sing, Davido don show face of new artiste wey dey him record label and him name na Mayokun. Na for one kain meeting like Dat na him DAVIDO for show the guy face give the world and he say na the guy go be the next big thing for Naija. Mayokun Adewale na graduate wey finish from UNILAG and the guy happy die. When he dey yarn he say he first think say na 419 O, when Davido send am message. He say na one kain small video where he dey perform wey he put on instagram na him DAVIDO like O. He say na God pick up him call O,  COS he don tey wey he dey pray for dis kain opportunity,  before God come catch DAVIDO for am. Na later we come know say the guy Mama na actress for Yoruba film,  wey her name na Toyin Adewale. So the entertainment thing dey the guy blood cos na still entertainment business him Papa dey do too. We say congratulobia to the lucky guy. Make God let dem story be like Dat of Usher and Justin Bieber cos na wetin e dey resemble be dat.... I Sha hope say una sign contract, COS I no wan hear story O! 

No comments: