Friday, March 4, 2016

CYMBALS DANCE GROUP SAY THANK YOU TO DEM 13K FOLLOWERS FOR INSTAGRAM

Nawa O... Bigga things dey happen for Ibadan O. Shebi na yesterday,  Thursday 3rd March we dey celebrate with MC OLYMPIA wey him followers for instagram reach 10k. Na so I just still see say Cymbals, the dance group wey don collect award taya for Ibadan and even the full Naija, don still reach 13k for instagram. The group wey be say dem no pass 3, na one of the best dance groups for Naija,  as dem don perform for plenty big shows,  for time wey no too tey na so dem still go clear awards for Next Rated competition wey happen for IB. Dem too much abeg... but I don't hear pipu dey complain about dem sha,  say dem go dey kill every show like say dem dey with a gun.... Lol.  If na you nko? We for TPN say congratulobia to CYMBALS.

No comments: