Minister of State for Petroleum Resources wey still be GMD for NNPC, Ibe Kachikwu, say na only arrange dem re-arrange the oil company dem Neva tear am to pieces. Na so he talk when he dey yarn with State House Correspondence after dem finish Federal Executive Council meeting yesterday March 9th. He say him din first explain for one kain press conference, say dem just re-arrange am ni.
He say dem get 5 business wey focus on business: Upstream, Downstream, Refineries, Gas and Power wey don dey there before. Dem come still get Ventures wey dey take care of all dem little companies. He say dem Oga go dey report to GMD. The NNPC na still one, so make pipu calm down. He say na pipu no just get the gist wella buy dem go soon make dem get am.
No comments:
Post a Comment