Thursday, March 10, 2016

FAYOSE SAY NO SHAKING, NOTHING FEDERAL GOVERNMENT GO DO TO MAKE AM CLOSE HIM MOUTH


























Ekiti State Governor, Mr Ayodele Fayose, on Wednesday say he no go stop to dey gbege Federal Government on top things wey dem dey do wey no make sense even as Department of State Security (DSS) pipu don dey shakara dem for him state, Ekiti. The governor, who show for the state from Abuja where he bin dey since Sunday for dem PDP meeting, said if he see anything wey government dey do wey no go make life beta for pipu,  he no go close him mouth O. 
According to one press statement wey him Chief Press Secretary, Mr Idowu Adelusi throway, Fayose who dey yarn for the first time on top how DSS pipu come shakara dem for the House of Assembly Complex, Ado-Ekiti,  wey dem carry away 4 honourables say dem Neva see anything cos he go still yarn plenty in the interest of Naija and our democracy. He say Bible don tell am say na pipu with God plenty pass and no be the first time NE dis wey pipu go hayaj am. are in he say na gang up and dem go fall as dem dey always fall.

No comments: