Monday, March 28, 2016

HABA... SEE HOW MANY COWS DINO MELAYE SAY HE GET FOR EASTER



Nawa for Naija pipu with famzing O. Person wey need something dem no go give am,  na person wey no get dem go dey carry dem life savings give. How one person go collect 28 cows for Easter, not Christmas O. 

After all everybody sabi say pipu dey kpain Animal for Christmas mata,  but how person go come see 28 cows for Easter. The thing funny so tey Senator Dino climb instagram come laff,  polongo himself say he don turn cattle rearer, anybody wey wan buy malu, make dem halla am. Naija Nawa O!


No comments: