Na so life be, you win some, you loose some, Na so e be for Shooting Stars yesterday when Nigeria MAN City, FC IfeanyiUbah flog dem 3-1 for Nnewi. IfeanyiUbah's Brazilian striker, Alberico Barbosa, Na him first score in the ninth minute with freekick. Sulaiman Mohammed na him score the second goal for dem for the 37th minute, na so Seka Pascal come take third goal finish am for first half. Na we beta pikin wey score 3 goals last weekend against MFM, Wasiu Jimoh, come score the only goal for 3SC for the 58th minute.
No comments:
Post a Comment