Chaiii... We Security pipu for Naija catch some badt guys yesterday. For inside dem we see 2 women plus plenty men, one of dem even form say he be pastor, carry Bible for hand. Wetin come make dem mata Taya person be say na inside coffin dem
package the heavy weapons wey dem dey carry Waka. Dem come carry the coffin inside one hummer bus, put lead forefront like say na dem body dem dey carry. Tori yarn us say na Ondo dem dey go from Lagos when security pipu waylaid dem. Toor.... We say una weldone ooo. Hope no be say na election wey go soon shele for Ondo na him some bad pipu don dey prepare for so?
No comments:
Post a Comment