Monday, March 28, 2016

ADONBILIVIT... SEE WHO DEY BRING PLANTATION BOYZ TOGETHER AGAIN





MISS SIMPLICITY - On top d Plantation boiz mata: Dis tori dey totori my body.. Faze, Tuface nd Blackface wey bin don breakup, makeup nd re-breakup don come togeda again O. Blackface bin accuse Tuface sey him thief him song nd d tin bin don dey cause wahala for tuface bt e be like

sey Chief Ateke Tom don rob mind wit d dem nd dem don forgive each oda nd dem don sama media wit d pictures wey dem take for d chief house for river state nd for d picture, dem dey laff nd drink togeda oo. On top dat mata my body dey sweet me like sey I be ant wey fall inside sugar...As I dey hapi reach sey dem don forgive demselves, na so I dey help dem pray sey make Baba God o, make He keep dem togeda... Tuface, Blackface nd Faze, we for TPN dey hapi for una ooooo

No comments: