Bad thing shele on Saturday night when one of the trucks wey dey carry Yinka Ayefele musical instruments go enter gallop for Lagos-Ibadan expressway and e commot for road go enter Bush, kpain one of the engineers wey dey inside and many other pipu carry injury. The person wey kpef, Mr. Tunde Oduneye, 39 years old na him dem confirm say he don kpain for UCH around 11:00pm on Saturday. For one release wey dem sign by the band megaphone, Mr. David Ajiboye, say na for one
wedding for the pikin of Olu Amore, who be Commissioner of Police dem dey go before the truck wey dey carry equipment back to Ibadan go get accident shortly after dem pass the old toll gate for Ogere. Tori yarn us say na plenty pipu dey beg, Yinka Ayefele, wey be leader of the band, for the Accident and Emergency ward for UCH where pipu wey woundjure for dey collect treatment. Tori come still yarn us say dem don bury the person wey die for him town, Ijebu Igbo on Sunday evening. We hear say he get one wife plus a 2-year-old baby. But sha O, as pipu kpain, na so plenty musical equipment wey him money dey enter plenty millions of naira still pafuka. We for TPN pray say make Baba God sama person wey kpain beta rest and make he sama Tungba master beta things.
No comments:
Post a Comment