Saturday, September 5, 2015

TORI TORI FIT DON STOP FOR ME O BUT MY TORI CONTINUE ON THE PIPU'S NEWS

As dem don dismiss me from work for Space Fm, say make i dey go my Papa house, wetin man pikin go do. I sha no go kill myself. Na him make me reason am o say make i go wake up dis my blog wey don dey sleep tey tey.



So my pipu make una no vex, say I no even fit tell una bye bye on top una darling programme Toritori plus including Sabi Una Right on Space Fm. God know say my heart dey with all of una.

But sha man fit stop Toritori with Afouda but no body fit stop the tori of Afouda, that na why I go continue to dey update, dey upgrade and dey entertain una everyday on top dis my blog THE
PIPU'S NEWS. I pray say make una gbadun am and help me yarn other better pipu say dem personal person, dem broda man on the radio Afouda Baba Agbalagba dey for here. k'olorun chanu wa!
Sent from my BlackBerry wireless device from MTN

1 comment: