Saturday, September 5, 2015

SEE CONFIDENCE O, GOV. AJIMOBI SAY MAKE WE NO GREET AM AGAIN IF LADOJA WIN FOR TRIBUNAL

Early today saturday Gov. Ajimobi, the Oga at the top for Oyo State dey on top Splash fm for the programme voices wey Edmund Obilo dey do.



Lie, no good, I no hear am for myself by myself as man pikin dey hustle for town as per person wey dem just dismiss from work. But i hear say His Excellemcy yarn plenty things o...the one wey he come yarn wey surprise me pass be say if former Gov. Ladoja win for tribunal make Edmund no greet am again...GBAM

Toor, the oracle don yarn make we all siddon denge pose dey look....but e no go funny if dem fall him hand ooo!


Sent from my BlackBerry wireless device from MTN

No comments: