One of the beta comedians wey dey make brain for Ibadan city, MC Solid dey obodo oyinbo for USA now dey flex with him family.
The Boss as many comedians dey hail am don go join him wife and pikin for USA, and to show say the guy na true Oga, him popular gospel comedy show wey he dey carry waka from church to church, Turaka With Solid still shele today, Sunday for Triumphant Assembly Shaback Center wey dey Agbowo.
Comedians wey dey there na Timmy, Dr. Frick, Cris Da Lecturer, Rev Comic, Parkage, G Jokes plus including your own Afouda Baba Agbalagba. Accorfing to wetin Timmy yarn he say na dis one gangan be Turaka with Solid in Diaspora.
We never know sha maybe he go gree come back abi he don go turn Mario for US ni.
No comments:
Post a Comment