Pipu wey dey stay for Majidun for Ikorodu Area for lasgidi don dey polongo o say Navy pipu don turn dem community to barrack dey do dem strong thing o. According to wetin dem yarn, na oil thief government say make dem come dey catch o, but we hear say dem don chase pipu commot from one full street come turn am to dem own dommot.
The one wey come be the pekele pekele for inside be say dem talk say dis oga navy's dem dey take by force dey chop women ogbono for the area. And dem dey take beating decorate the guys for the area. Dem say dem dey even force dem drink gutter water as per punishment. if this na true Nawa O! if power dey shack dem make dem carry dem go sambisa o
Sent from my BlackBerry wireless device from MTN
No comments:
Post a Comment