
Tuesday, September 15, 2015
NA FROM CLAP DEM DEY ENTER DANCE, NASO TUNDE OLAWUWO FOR SPLASH FM TAKE ENTER BBC FOR LONDON
No be small mata o, as Ibadan pipu no dey play with dem work. Shebi una sabi Tunde Olawuwo wey dem still dey call Corper Tee, from tey tey na him the bros don dey splash dey do Sport Bang and him still dey do Voices sometimes if Edmund Obilo no dey. Na so we see am yesterday o wen Splash fm send one kain famzing tweet, say se our guy dey rock am for BBC London. Just like dat, yes na, but sha o dem no yarn us wetin he go do for there gangan...abi he don join BBC niyen? Anywhich way congratulobia bros. E no easy!
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
1 comment:
Maybe he is there for training
Post a Comment