Our
Oga patapata for Senate, Sen. David Mark talk yesterday wen him dey decorate
police officer wey den just promote say we no dey gree this yeye Boko Haram
pipu again. He say no mata wetin dey pain dem for body, make dem come out come talk am with
Federal Government no be say make dem just dey kill pipu unto say dem dey vex
for wetin nobody know.
He say if dem refuse to hear wetin we.....sorry......wetin him dey tell dem, dem go force Federal Government to use strong head take solve the problem, but he say na to discuss am like better pipu go better o cos wetin dey face Naija now plenty pass make we dey fight one kain war.
No comments:
Post a Comment