- By OJOBARO Babatunde **MC RAIN**
E
b like say this Boko Haram people wan dey show themsef too much, we sef we go
let them know say difference dey for six and half-a-dozen. Naso the minister of
interior, Comrade Abba Moro yarn on Tuesday 11th of March 2014.
He
talk say na wetin we need now be that especially for our boarders wey dey for the
North. He say him full mind dey tell am say this Boko Haram people dey import
wicked and devilish foreigners wey dey help them kill our people and na this
our boarders dem they go and come inside our obodo naija like say na thier fada
parlour.
The minister come quick remind us say even though the boarder get as e be for now but say them dey work on making that boarder dey kampe, he say na regularly dem go they use the flying element to navigate the boarder so that e go compliment the ignoble official wey dey use land navigate THIER Own. He say with the plan wey dey ground, Boko haram wahala go soon reduce as hin men don even kill 210 members of dese boko people for gun fight last week inside sambisa forest where them camp.

No comments:
Post a Comment