Tuesday, March 11, 2014

NA ALL OF UNA BE CRIMINAL, JEGA RAKE FOR ALL POLITICAL PARTIES.




Oga for INEC don talk am o, say na all our politiacal parties for this country dey go against dem electoral Law wey say dem no fit start campaign until 90 days before election.

But he say all dis one na story o, as all the parties no dey gree. Na so so poster dem don dey see wey dem take dey campaign, he say him dey warn dem now make dem take time cos anybody wey dem catch na him dem go take do scape goat for the others. He say anybody wey dey tell us now say make we vote for am in 2015 na offence e dey commit, say even though dem fit do rally, but make dem no turn the rally to campaign o.

He come even clear am say make we relax dem go do better election for us this year, say na just one simpke mistake dem do for Idemili North Local Government wey bin wan spoil dem good work for election wey dem conduct for Anambra State, but him don forget that now as dem don go hire pipu wey over sabi to come help us with the next general election, so make we relax cos na better go happen.

No comments: