Former
Oga Governor for Abia State don loud am yesterday o, he say na OBJ yeye pass
for all the President wey don siddon on top our government for Naija since
oyinbo pipu free us in 1960.
Na for one lecture wey dem arrange for Economics Department, University of Nsuka, he for talk am on Tuesday. He say instead make OBJ dey create work like a better presido go do, na so so close he dey close pipu business. He say make e no be like say him no get evidence OBJ close down Hallmark Bank and Slok Air, companies wey suppose dey give employment to our youths for Naija.
Na later e talk wetin dey pain am gangan, say OBJ close down those businesses to take punish am ni cos him get hand and mouth for those compamies. He come say make the state try empower the youth cos no better fit happen for anywhere wey dem no dey do better for the youths.

No comments:
Post a Comment