Oga
Governor for Plateau wey still be the Oga for Governor's meeting (wey Federal
Government recognize) don loud am yesterday say him and the other Governors wey
gather dey him side no follow for the yeye retreat wey dem Amaechi side dey
arrange.
According to him person wey talk for am, Kassim Yakubu, he say the story wey dem dey hear be say one meeting dey come and dem dey mention dem pipu say dem go follow dey the meeting. He say na him make am come tell us say na lie o, dem just dey try package the meeting make e be like better one for our face, make e no be like the yeye one wey dem do for Sokoto last year.
He say dem no go fit be that kain meeting wey be say na so so yab dem dey yab, dey swear for Federal Government for the meeting, say make we dey look am o, na yab dem still dey go yab Federal Government for this dem yeye meeting.
No comments:
Post a Comment