Tuesday, March 11, 2014

NA MASSOB PIPU GO HAYAJ GOVERNMENT HOUSE FOR ENUGU O- POLICE


Oga Police for Enugu State don talk o, he say wetin dem don find out show say the pipu wey go hayaj Enugu State Government House early momo last week na members of Movement for the Actualisation for the Sovereign State of Biafra (MASSOB), the group wey dey fight say dem wan stand on dem own as Biafra country.
Na Oga Police for Enugu, Mr. Abubakar Mohammed talk the mata wen him dey gist with News pipu, say na four pipu dem arrest plus including one of dem wey wounjure well well, but say no body die for the mata o. He say wetin dem collect from dem hands na 2 big banner wey carry Biafra Symbol, 34 flags wey be for other countries, plus including one big bag wey get matchets, charms and one saw (wen dem no be carpenter) but say dem no get gun o. Oga Police say wen hand touch dem wella dem don dey confess winsh, say na some pipu hire dem make dem come tako over Government House, and dem don even mention the pipu wey send dem dat kain message. He say him boys don dey find the pipu wey dem mention and na wen dem catch those ones dem go fit know wetin dem dey try to achieve for the mata.

But MASSOB Oga, Chief Ralph Uwazurike say na lie o, no be dem members, say even from dem name you go know say dem no be MASSOB member.

No comments: