Tuesday, March 11, 2014

CONFAB NO FIT MAKE SENSE IF UNA NO INVITE BOKO HARAM PIPU FOR THE MATA O.




Wonder they say no go ever end, especially for this our Naija. Na him make one lecturer Professor Timothy Uzodinma Nwala for Philosophy Department wey dey Nassarawa University, but who bin don lecture before for University of Nigeria, Nsuka.

Na for one interview the prof for talk the wonder o, wen dem ask am question on to say he bin member for 1994/95 Constitutional cvonference wey Oga Sani Abacha bin call that year.He say that time na brain dem take run the package cos the country bin wan scatter that time for Abacha hand, so dem come call beta pipu from all over Naija make dem come do the thing and dem do am well, wey be say Oga Abacha no fit take do anyhow with the result for the Conference.

He say as the mata come be now, we no go make sense if we say make we come yarn how Naija go move forward without say we call dem Boko Haram pipu make dem come follow us sit down talk the matter. He say dem Boko pipu get mouth wella for this country now, so if we call dem make dem come talk wetin dey pain dem, all of us go know and we go vote. So if we no vote for dem own mata dem go know say wetin dem dey fight for no sweet Naija Pipu's belle (but you sure say dat one no go make dem vex). He say na white lie be all the excuse wey some pipu dey yarn say dem no know Boko Haram pipu, say shebi dem don arrest some of dem wey dem free. So that one no be excuse at all.

He say wen Abacha no fit do anyhow with the result of dem own conference, he just siddon on top am. That one make me laff sha o. Boko pipu abeg send the list of una delegate O, may be through the Prof.

No comments: