Eeyah.............Oga Sanusi Lamido Sanusi, wey be former Governor for our central bank for Naija don talk am for one interview wey dem print come out for inside New York Times on Monday say him don start to dey find the money wey dey hide wen Federal Government tell am make he dey go back to him family house.
He say him do one kain meeting with dem Oga for Banks on February 11, where him for gbege dem seriously, say him go start to dey open dem books dey find where the money dey hide o, cos him dey suspect say na for inside dem book the oil money wey some pipu thief dey hide, as some of dem no dey gree talk wetin dey inside dem book again.
He say as him talk the mata finish, dem liver start to dey fail dem and na him make some of dem run go report am to our minister for petroleum, and we all know say na to scatter the name of anybody wey dey try that kain thing Federal Government dey always do. He say na dat assignment Federal Government no wan make he do, wey make dem ask am to dey go home.
But sha o, Dr. Reuben Abati talk am for him email say make we no mind Sanusi o, him just dey find wetin go make Naija pipu dey pity am ni, say the guy fumble wella, as him just spend money anyhow, no do wetin dem dey ask am, and do some criminal magomago.
No comments:
Post a Comment