Our
fine Oga Madam for petrol matter, Diezani Allison-Madueke don yarn on tuesday
o, wen she dey defend dem 2014 budget for Hose of Rep (Committee for Petroleum
Resources plus Gas) .
She say all the rumour wey dey fly anyhow for town say dem dey get mind to increase petrol money na lie o. Say she fit talk am habatically say dem no get dat kain tin for mind. She say true true dem know say long line dey show face for petrol stations wey dey some state cos say some long throat marketer bin dey hide the petrol like say dem fit drink am, she say na small issue dem bin get with supply for petrol but dat one don get solution now. She come drop voice say any petrol station wey dem catch now say dey hide fuel, go smell pepper, even if na Government get am.
No comments:
Post a Comment