Monday, March 3, 2014

MARK SAY MAKE WE DEY DO KIDNAPPERS STRONG THING.



Our senate presido for Naija, Oga David Mark, on Sunday don continue hin shout say make we find beta and harder punishment for dem kidnappers. That kain punishment wey go fit commot those bad boys from circulation patapata. But sha o Oga Davido no gree talk the mata himself, na through him chief press Secretary Mr. Paul Mumeh he yarn for Abuja (who no sabi hide him head).

 

Government for Anambra, Edo and Delta don already gree for the law wey say na kill make den dey kill any kidnapper wey den catch plus including make den dey scatter dem house wen den catch dem. Na for the burial ceremony of Late James Iloenyosi, wey die for dem kidnappers dommot he for talk……sorry……..for send the message at St’ Marks’s Catholic Church, Abagana, Anambra.

Bro Mark talk am for St’ Mark say na big yeye the kidnapping matter dey put for our country body o,  and if we no do the kidnappers strong thing den no go stop the bad business.  
    
He say the yawa dey gas for all of us for naija and government no dey run from their responsibility, but make we country people no just sit down dey look like lukozade, make we join government to find a way out. He yarn with vexation say the bad people wey dey do the kidnapping thing no be spirit na, na for we area den dey bunk, so make dem chairman for we areas try catch or at least point out the boys wey dey do that kain thing for their dommot. He say today na the old Baba die, but we no know which person or person papa he go be tomorrow (make we dey pray for Bro J’s Uncle o). He still advise say make all we Naija people no gawk am o, say make we dey shine our eyes wella and make we ready to fight against dem boko boys wey dey cause serious gbege for Borno, Yobe and Adamawa. He say with the way the boko boys dey vex this few days, na gather we go gather hand beat dem o, if we really wan win dem.

Make he for no be like say he no come Gov. Peter Obi sef yarn the peple wey dey the burial, especially community leaders say make den try  help him government to wipe out the bad business for the state.

When the family of the man talk their own den say den don submit to the will of God o, say wetin make dem dey happy be say their papa try wella for him community wen he dey alive.

1 comment:

Anonymous said...
This comment has been removed by a blog administrator.