Miss Simplicity - On top fashion mata, one tin na make you wear cloth nd na anoda one naim be sey make d tin fit you wella oooo... Na so d mata be for Empress Njamah wey her broda John Njamah just do wedding nd wey be Nollywood actress o, she make sense wella for d foto wey she sama her fans on top her IG page o..
Di actress wear wine color custom outfit, she com nack ham wit bag nd wey fit d clothe nd last last she com put dark shades to take complete d dressing mata nd d tin fit her no be small...
See anoda foto afta d cut.....
Saturday, July 30, 2016
(FOTO) EMPRESS NJAMAH GET SWAG WEY DEY MAKE BRAIN...
(FOTO)SEE WETIN ODUNLADE ADEKOLA WAN SAMA HIM FANS WITH OOO
Miss Simplicity - E wan be like sey na big tin naim go soon tanda gidigba for our screen base on sey na correct ogbonge actors nd actress naim dey for Abeokuta now for where dem for dey shoot one film wey Odunlade Adekola wey be Glo Ambassador wan produce o..
Di tori dey tok sey na Timu Timu naim be d name of d film wey dem dey cook so o nd na pipu like Lola Idije, Yemi Solade, Fathia Balogun, Mr Latin nd plenti plenti like dat naim Odulade dey feature for di film mata o...
Yes o only d pipu name wey dem mention so, me I don knw sey d film go make brain nd dem don eben tok ham sey make we seat back, relax nd dey expect d film wey dey road dey com oooo..
See sum of di pinshures wey dem take for di set afta d cut....
Friday, July 29, 2016
(FOTO)NATURAL HAIR TINS: SEE HOW DIS BRIDES HAIR MAKE BRAIN...
Miss Simplicity - Natural hair na one tin wey no dey easy to maintain base on sey di hair no dey like respect or obey d person wey get ham nd di tin even if com be nuisance for person life naim make ham many pipu wey wan marry dey like fix weavon to take cover their hair o bt sum pipu wey call demselve Team natural prefer to cruise their natural hair even for their wedding day o...
Na evribody know sey many Naija babes dey like do their wedding for Saturday nd dem dey like do fine style for their head naim make we for TPN wan sama di ones wey wan do their wedding dis veri tumorro wey we dey see so sum pinshures of brides wey decide to work wit their natural hair for their wedding day oooo...
See pinshures afta di cut....
(FOTO)TUSH MAGAZINE GO SOON SAMA US WITH NEW EDITION ND DI PIPU WEY DEM YARN ABOUT FOR DI MAGAZINE NA OGBONGE PERSONALITIES... SEE DEM
Miss Simplicity - Na Adekunle Gold, Aramide nd BOJ naim tanda for di cover of di 13th Edition of Tush Magazine wey dem go soon sama di public o...
Di tin wey di magazine wan do be sey dem wan appreciate pipu like Adekunle Gold, Aramide nd plenti pipu like dem wey dey carry Naija Music Industry go greater height o...
No be onli dat one, di magazine sef gather many many ogbonge personalities for inside di edition o...pipu like Josh Amor, Uti Nwachukwu, di veri DJ Coublon nd Lola Ojetola wey dem call their new crush o...Na all dis pipu naim get correct correct beta tori to yarn for di 13th Issue/Edition wey Tush Magazine go sama us soon oooo...
Make una see their pinshures afta di cut...
Wednesday, July 27, 2016
(FOTO) SEE HOW KIM KARDASHIAN ND HER PIPU TAKE DO THEIR SHOPPING O
Miss Simplicity - Yes o, di veri Kim Kardashian nd her pipu: Maria Menounos, Tracy Romulus, Kisha Madrid, Lala Anthony nd Carla DiBello naim kawasaka enta plenty shops for Crystals wey dey Last Vegas nd dem enjoy demselve o.
Weda make we call di shopping " hanging out tins" abi Ladies day out" bt any which way their pinshures dey show us sey dem enjoy demselves like sey tumoro no dey nd like sey dem no get anytin wey dey worry dem for mind o...
See plenti of their pinshure afta di cut...
(FOTO) EBUKA SWAG MAKE BRAIN ABEG...
Miss Simplicity - Ebuka Obi-Uchendu wey dey host shows nd wey be media personality naim don sama us wit foto wey he take wey he wear Mai Atafo suit o nd d guy make brain for di foto dem oooo...
See d pinshures afta di cut...
(FOTO)CONGRATULOBIA!!! AISHA SALMA DON MARRI OOOO
Miss Simplicity - On top famili mata, Aisha Salma wey bin dey date one naija guy nd wey bin introduce d guy give her papa nd mama for 2014 nd wey be Miss Uganda before before naim don readi to start her own famili o..
Di lady wey bin black nd wey bin win 2003/2004 Miss Uganda title naim don marri her handsome old lover wey be white man for Miami wey dey Florida o....
Ma'am Aisha sef com confirm ham sey she bleach her body wen she tok sey na she get her body o nd na anytin wey she like naim she go do for her skin o nd sey na her right oooo...
Yes o we know sey pipu go don dey throway salute nack her since d marriage bt make e for no lost, we for TPN too dey sey congratulobia to di two pipu wey dey start their famili so o..
See d wedding pinshures afta di cut....
Tuesday, July 26, 2016
ON TOP ALBUM MATA: ADEKUNLE GOLD DON CHANGE HAM FOR IM FANS O
Miss Simplicity - Na on di 28th of dis veri month naim Adekunle Gold wey be our ogbonge musician sopoz nack im fans wit him first album wey he call di name 'Gold' o bt d guy just decide to change ham for evribody di way WizKid bin change ham for pipu for 2014 wen im nack dem him album 'Ayo' for iTunes before di date wey he tok sey him go release ham o...
Oga Adekunle sef don sama im fans wit im new album for iTunes yestaday instead of on di 28th o..
Na only Simi naim Adekunle Gold feature for di album wey get 16-track nd sum of di song for di album, na Simi mix ham o...
Yes o I dey see tins on top dat level bt I go just dey here dey observe o...meanwhile make all of us go listen to di song dem for iTunes o, make we no fall oga Kunle hand o...
(FOTO) SEE HOW OMONI OBOLI TAKE DEY ROCK HER NATURAL HAIR
Miss Simplicity - Na plenty girls today naim biliv sey if pesin wan fine, d pesin go nid to du weda Brazilian hair abi put attachment for head bt Omoni Oboli wey be one koret actress nd producer wey Nollywood get naim don prove dem wrong wit d way she du her hair o...
Omoni Oboli nd plenty actress naim don grow their hair for natural way nd d tin fit dem no be small o...
Make una see some of Omoni Oboli pinshures wey show sey we fit carry our natural hair nd still dey fine o...
See dem afta di cut...