Friday, June 10, 2016

SCHOOL MISTRESS WEY DO SOMETHING FOR ONE 4-YR-OLD FEMALE PUPIL DON PIAKA

The 27-year-old schoolmistress, Violet Enu, wey den arrest plus give bail by the police for Lagos ontop say she do the thing for one four-year-old female pupil of Light Bearers Private School, wey dey Isashi area of the state, nahin den say don run comot her tamak. Tori yan say the suspect, wey do the thing last Thursday, piaka after den move the case from Badagry Magistrate's Court to Apapa Family Court for Tuesday. Den yan sy wen the parent of the pikin go report the mata for police station on Wednesday, Enu o show face.

No comments: