FOR those of una wey get talent to dey read pipu mind, we need una talent for dis funny pinshure o, abeg who fit help me read wetin dey dey go on for Rolake Bello mind for dis pinshure? Na for one event wey shele for time wey no too tey for Top One Garden, na so her fellow OAP, Da 13th Disciple wey dey work for Lagelu FM, dey go hail one babe wey follow Rolake Bello wey dey work for Fresh Fm siddon, although the hailing come be like kissing, especially Flinn person dey look am from where Rolake siddon. (see the pinshure below)
So abeg shey from the way Rolake do face for here, na envy she dey envy the babe ni abi she dey pity her, abi she dey vex abi she Kurt dey look say na which kain thing be dis one now? I don try read the mind from the face but I dey confuse? Oya tell me of you Sabi abeg??? See the pinshure afta the cut...
No comments:
Post a Comment