Wednesday, June 15, 2016

FINALLY...FINALLY.. AYO ORITSEJAFOR DON COMMOT FROM C.A.N. PRESIDO OFFICE

Many pipu don dey think say kasala go burst but Alleluyah Dat kain thing no shele on Tuesday, when dem elect the Presido for Nigerian Baptist Convention, Dr. Supo Ayokunle for Abuja as the tear rubber Presido for the Christian Association of Nigeria. The new CAN Presido we hear say gather 54 votes to take win Prof. Joseph Otubu of the Motailatu Church Cherubim and Seraphim Movement wet get 28 votes.
Tori yarn us say Ayokunle contest under the aburada of the Christian Council of Nigeria, Otubu do hin own under the aburada of the Organisation of African Instituted Churches. Na Papa Ayo Oritsejafor wey dey commot as presido na him polongo the winner the Ecumenical Centre, Abuja.
Tori yarn us say na only the 2 of dem drag the mata, but na for July Oritsejafor go hand over.

No comments: