Monday, June 20, 2016

HIJAB PALAVA: PDP WANT MAKE THE FULL WORLD DEY MONITOR AREGBESOLA

THE Osun State chapter of the Peoples Democratic Party, PDP, yesterday don dey beg security agencies, Interpol, the Presidency plus United Nations make dem dey monitor activities of Governor Rauf Aregbesola wey den yan say fit cause religious gbege for the country. The party, for one gist wey den drop for Osogbo by den megaphone, Prince Diran Odeyemi, yan say Governor Aregbesola ontop the hijab mata wan carry am cover up hin mismanagement of the state human and material resources.  The main opposition party for the state yan say even as Boko Haram dey hayaj churches plus mosques Christians plus Muslims for the country no divide.
But since hijab mata don shelle for Aregbesola administration for Osun, Christian Association of Nigeria CAN plus Supreme Council for Islamic Affairs SCIA, don begin do anyhow, dis wan nko nahin fit cause gbege for the pipu wey don dey together peacefully since.

No comments: