Otunba Femi Fadipe wey many pipu still sabi as Alaafin Alujo, don sama him fans beta news yesterday when he climb on top him Facebook page go polongo say dem corporate office for LANCASTER RECORDS don ready and dem go soon open am for Ance Building, 3rd Floor for Magazine Road wey dey Jericho, Ibadan. Oyo - State for we Naija. So make una stop to dey talk say tungba no get packaging O, na corporate level now and Bros no dey carry last. We for TPN say congratulobia boss, sha call us if parry dey.

No comments:
Post a Comment