Friday, June 17, 2016

8 KPAIN, 3 WOUNDJURE AS PASSENGER BUS NAK TIPPER FOR THIRD MAINLAND BRIDGE

EIGHT people nahin kpain for one accident wey be say na one moto carry head go nak tipper wey den park for road for ontop Third Mainland bridge. The accident nahin den say shelle for about 11.30 p.m. Den yan say the moto dey full speed so wen e carry head nak the tipper almost all body of the buss nahin spoil from front reach bak. Tori yan say eight pipu nahin dem say kpain instanta before den rush dem to General Hospital, Gbagada for treatment.

No comments: