MISS SIMPLICITY - D Nollywood actor wey wey know as RMD don dey use him instagram page as way to give correct correct advice to him fans.. Today d actor advise him fans on how to take handle fame nd he tok sey na humility be d key o.. He sama him fans wit one picture wey make sense wella nd on top ham, he write sey no be to gain fame naim be d koko bt na d way to handle ham naim be d real tin. He tok sey na person ability to fit handle fame wit humility naim go make d fame stay tey for d person hand o. He tok sey na being humble naim be d confirm way to handle fame... Confirmento, thank you for d advice sire...na true tok u yarn
No comments:
Post a Comment