Friday, April 29, 2016

BUHARI DON READY TO SAVE STATE GOVERNMENT FROM SALARY GBEGE

Buhari say e dey pain am O, say plenty states of Naija still dey find am difficult to pay salary payments even as Federal Government don Roger dem money wey dem call, bail-out funds. When he dey talk for meeting wey he do with members of the Nigeria Governor Forum for the Presidential Villa yesterday April 28th, President Buhari say e dey disturb am when he reason the kain suffer wey state government workers for the country and dem families dey face. To come reduce the suffer, Presido say Federal Government go try give money to the states, dem go see how dem fit return money wey States don take maintain federal roads plus other money wey dem spend for Federal Government. He say dem go arrange one kain inter-ministerial committee wey go study how dem fit take re-arrange we country money wey Governors present give am. Buhari say the committee go see how dem fit improve the money wey dey enter for the state governments and see how dem go sharperly for do am.

No comments: