The babe of we Presido, Aisha Buhari, don start the Future Assured Initiative, wey be awoof Health Screening for Women, for Loyola College, Ibadan, Oyo State yesterday April 28th. Pipu wey follow her Waka come na, Wife of Delta State Governor, Edith Okowa, Wife of Ogun State Governor, Olufunso Amosun, Wife of Osun State Governor, Sherifat Aregbesola, Wife of Edo state governor Iara Oshiomole plus many others.
For the event, dem sama awoof screening give more than 2500 women on Breast Cancer, Cervical Examination, Blood Pressure plus Blood Sugar screening. And as dem dey test dem, na so dem dey sharperly treat dem, dey sama dem free drugs to take treat wetin dem test dem for.
No comments:
Post a Comment