Sake of the Aluta wey shele yesterday for Ibarapa Poly, wey be Ibadan poly (eruwa campus) before, tori confirm say dem Oga for the school don free everybody say make dem dey go house. Dis one na as student and police enter the same trouser sake of say the school dey change courses for some HND students come still
add join school fees. We hear say Police bullet touch one guy and one babe wey get asthma dey hospital dey collect treatment. But for now dem don free the students, say make dem go calm down for dem Papa house.
No comments:
Post a Comment