Tuesday, March 29, 2016

R. I. P. - SEE HOW ISIS KPAIN REVEREND FATHER TO TAKE CELEBRATE GOOD FRIDAY





Chaiii... ISIS terrorists don still do some bad things again O,  dem don nail one priest wey dem kidnap dis month for cross. Father Tom Uzhunnalil, wey be Salesian priest, na him dem catch when 4  militants go hayaj old pipu house for Aden wey dey Yemen on March 4. Tori yarn us say dem kpain am with the style wey Romans take kpain Jesus Dat year. And dem do am on good Friday,  the same

 day wey history tell us say dem crucify Jesus too.  Father Uzhunnalil na from India and as dem dey pray,  na so him country dey hustle to free am since dem catch am on March 4, where dem for kpain 16 Christian nuns plus nurses. Bishop Paul Hinder, wey be Oga for the Catholic Church for Yemen, say ni be today dem dey threaten dem for the Missionaries home, but dem no go gree commot. On Sunday, we hear say Pope Francis don polongo dem and honour the pipu wey dem kpain plus the reverend father as pipu of God wey kpain for God work.

No comments: