IPOB say dem DSS plus we Federal Government dey plan, dey arrange say dem wan kpain dem Oga, Nnamdi Kanu next time he dey go court to answer him way to him mata with Federal Government. IPOB for one statement wey dem sign by dem Media plus Publicity Officer, Mr Emma Powerful. Tori yarn us say wetin
dey inside the statement na wetin FG, DSS plus 3 Governors from the Southeastern States dey plan say dem wan kpain Mazi Nnamdi Kanu, dem Oga for IPOB wey still be Oga Director for Radio Biafra on. Dem say na big big APC pipu plus 3 Governors from the South East plus some Senators from the same zone and some pipu wey dem Sabi wella say dem be enemies of Biafra gather dey the meeting where dem dey finish plan of how dem go kpain Mazi Nnamdi Kanu.
No comments:
Post a Comment