Thursday, March 31, 2016

ON TOP WETIN... SEE AS TEEBILLZ TEAR FOR ONE FAN OF TIWA SAVAGE

MISS SIMPLICITY - Fans don para for Teebliz on top d answer wey he give one of Tiwa Savage fans. On Tuesday wey tiwa dey celebrate sey she don get 100,000 fans for instagram, one of her fans wey dem call Osayuware Isibor @donforeign com post sey "Make dem tell Tiwa Savage make she shoot d video of d love me hard wey she nd 2face sing bcos if she no bring d video out, she fuck up be dat ooo. Teebillz no let ham cold before him sef answer d fans sey @donforeign tell ur mama nd papa make dem send u go music skul make u for fit dey do all d yeye video wey u wan dey do wit ur stupid sef. Chai dis one no go well wit d other fans as demself come dey blast Teebillz sey wetin wan cause dat nonsense? Sum even tok sey make him beg ooo bcos na dem dey make Tiwa move o sake of sey if dem no be her fans, then who go knw her o. Sum tok sey Teebillz fuck up big time o. One com even tok sey abeg o no come dey vent anoda person anger on ur wife fans ooooo Hmmmm...I comment my reserve.

No comments: