Nine lawmakers for the Ekiti House of Assembly don tear race go Ibadan, the Oyo State capital, sake of say dem believe say dem life no safe for Ekiti. The lawmakers, wey do one kain news conference for Ibadan, on Wednesday say some detectives from the Force Criminal Investigation Department, Abuja don and for Ado Ekiti on Tuesday and dem Sabi say na dem, those pipu come catch. Dem say na one Chief Superintendent of Police, Mohammed Abubakar na him leas dem come, dem say dem see some APC guys dey point dem house give those police, Dat na why dem clear commot from Ekiti. The Assembly Committee Chairman for Information, Youths and Sports, Gboyega Aribisogan, na him yarn for all him pipu for Ibadan. He say dem gats come Ibadan come loud wetin APC government dey do dem again O.
No comments:
Post a Comment