MISS SIMPLICITY - Ini Edo don para for her fans wey bin dey yeye her on top d dress wey she wear go d AMVCA. She tok sey na art work wey one man do nd she wear ham bcos d dress show sey d man get brain die. she don tok sey make pipu keep their yeye comment o nd she com dey beg dem sey make dem kawasaka comot for her page if dem no fit close their mouth nd if dem no fit appreciate anoda person beautiful work...d actress para finish wen she com tok if u go check now,u go see sey d pipu wey dey yeye her dress na pipu wey no get beta talent oo,chai see finishing..D actress tok sey na only worwor person go call dat dress wey she wear worwor...I dey feel u ma'am...
No comments:
Post a Comment