The lawmaker wey dey represent Ibadan North East\South East Federal Constituency for the House of Representatives, wey dey Abuja, Hon. Adedapo Lam-Adesina a. k. a. Omo Oloore don do beta again yesterday, 9th March, 2016 when he sama beta money take support, improve abi start-up businesses for 250 small traders wey dem pick carefully from him constituency under wetin he call, Omo - Oloore women Support Scheme.
Na Dat one he take mark the 2016 international women's day wey dey happen on March 8th ,every year. He say he no wan make government just dey look pipu, no dey help dem. He say he take dat one to fulfill one of him promises wey dey inside him 8point integral action plan wey he polongo when he dey find pipu wey go vote am. He come beg dem make dem carry the money and opportunity do beta for dem life as things be one kain now for the country.
No comments:
Post a Comment