
Sunday, September 6, 2015
LIKE PLAY, LIKE PLAY TOOLZ AND HER GUY DON DO INTRODUCTION O
If you still dey dream say one day you go hold Toolz plus including all her plenty plenty tinz, I pity you o. Simply bcos her guy man, Captain Tunde Demuren don carry him full family go meet dem Oniru family o say him wan marry dem orente daughter.
Make una no forget say na May dis year, the bros ask am for public if he go marry am and when she no dey craze nko, she tell am say she go do and even last month Aproko pipu talk say dem see her for New York dey buy wedding gown. Toolz wey get real name Tolu Oniru na talk talk babe for beat99.9fm for Lasgidi
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment