Thursday, March 31, 2016

MAKE E FOR NO LOSS, SEYI LAW AND HIM WIFE CELEBRATE 5 YEARS TOGETHER

MISS SIMPLICITY - Dis tori don suppose nack una door bt as we knw sey fuel mata for Ibadan nd d whole naija no easy, naim make dis tori stay for road tey nd base on who d tori tok abt nd who una be, I com sey make I still try yarn una d tori....Seyi Law nd him wife do their 5th yr wedding anniversary dis week nd to celebrate d tin, dem two com renew their marriage vow... The comedian dey hapi sey d wife tanda gidigba for d five yrs wey dem two don dey togeda, na so he com sama media wit the picture wey dem take for d party nd on top d pictures, Seyi law tok sey d wife naim strength o, make I show una hw him write ham "I looked into your eyes several times, but the burning desire never ends. Your beauty is not of the outward, but within. Your strength is in accommodating without complaints. You are an epitome of Amazement. A creation of Excellence, The definition of Greatness,And a Heart Of Pure Gold. Love You" Chai see love...me sef I go love ooooo. congratulobia.....

No comments: