Some Pipu wey be hire killer don kpain Michael Ogunnusi, wey get Allonze Hotel for Ishawo Road, Agric, Ikorodu, Lagos State. Tori yarn us say the bad guys carry Okada enter the hotel come pretend like say dem come stay for the hotel. Dem first tie the security man wey open gate before dem Waka enter the man room and dem shoot am die. Tori say dem fall the man sake of say he dey run package with the Oga of the pipu wey come kpain am. We still hear say dem even carry him phone before dem clear commot from the hotel. One person say dem be 4 and dem bring car, wey dem park outside the hotel. Dem say one of dem dey inside the car, and na 3 of dem go inside the car. But police pipu say the thing shele around 11pm on Wednesday, still explain say the bad guys first tie the gateway, before dem kpain the man.
No comments:
Post a Comment