Friday, May 20, 2016

ALIAMDULILAHI PLUS ALLELUYAH.. SOLDIERS DON RESCUE ANODA CHIBOK GIRL

Soldiers tok say dem  see second abducted girl, Serah Luka, for one rescue operation wey dem do last night. Army spokesman Col. Usman Sani Kukasheka tok say Luka na hin dem believe say go be  the daughter of Pastor Luka, wey be one of the parents of the missing Chibok girls. He stil com dey add join say the girl na she go be number 157 on the list of the 219 missing Chibok girls. For the op wey dem take save the girl so, the troops kill 35 Boko Haram terrorists com still recover several arms and ammunitions plus other items.

No comments: