Monday, May 23, 2016

AYO AJEWOLE... WOLI AGBA DON CARRY FIRST LEG TO ENTER MARRIAGE LIFE

Ayo Ajewole, wey everybody sabi as Woli Agba wey be one of the ogbonge members for Christ Chosen Vessel wey everybody sabi as ALFA SULE don dey take style dey do seke seke seke bula commot from bachelor life. As e do him introduction for last weekend with him darling darling babe. Na dis morning the picture begin show face for Internet where Agba Woli scatter body inside white agbada, normally we for think say na film dem dey do but with the way he take normal for the pinshure, e be like say na real life no be play. We for TPN wish dem all the beta things wey dey make marriage sweet.

No comments: